Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 37:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Doz wey dey fear God dey advise pipol well and dem dey tok wetin dey rite.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 37:30
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go tell evribody about yor raitiousness and evriday, I go always dey tok about di pawa wey Yu take dey save, even doh I nor really fit esplain how e bi.


and till I die, I go always dey tell pipol about yor good works, bikos evribody wey dey try to kill mi, Yu don disgrace and make shame katch dem.


Di words wey betta pesin tok bi like pure silva, but wiked pipol words dey yuzles.


Many pipol dey gain from word wey betta pesin tok, but stupid word fit kill pesin.


Raitious pipol dey tok with sense, but anybody wey dey tok bad tins, go die.


Na good advise dey kom out from wise pipol mout; but foolish pipol heart nor get anytin to give.


Just as perfume and fine oil dey make pesin happy, na so too betta advise from pesin friend, dey bring joy to en heart.


As good pesin dey bring good tins from en heart, na so bad pesin dey bring bad tins from en heart too.


Make una nor allow any bad word kom out from una mout, but make una word dey give poor pipol hope, so dat e go bless pipol wey hear am.


Make all of una word dey good and sweet like wetin dem put sugar, so dat una go know how to ansa evribody.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ