26 Dis pipol dey always happy to give and blessing dey follow dia shidren.
Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.
Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.
Bikos E don make di iron for una gate strong kon bless all una shidren.
Wen wiked pipol borrow sometin, dem nor dey pay back, but doz wey dey fear God dey give tins to pipol with happiness.
Good pipol dey always do di rite tin and God dey bless dia shidren.
na wetin dem go like get, dem dey always tink about, but good pipol sabi give well-well, bikos dem nor stingy.
Di only tin wey I go let dem do for dis life: na to always dey honor mi, bikos na for dem and dia shidren-shidren good.
God go bless una wey dey sorry for pipol, una go receive mesi.