Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 37:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 God dey guide innocent pipol evriday and dem go get propaty wey go last forever.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 37:18
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.


But God love go dey forever for pipol wey dey fear am. En salvashon go dey for dia shidren-shidren;


Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.


Wen e sey make Yu save en life, Yu do evritin wey e ask for and en family go rule forever.


My future dey yor hand. Make Yu save mi from my enemies pawa, bikos dem won kill mi.


I go happy and dance for yor love wey nor dey fail, bikos Yu don si my trobol and Yu kare about di pains wey dey my heart.


But God just dey laf, bikos E know sey di day to judge dem, don near well-well.


So, wetin go make mi fear wen trobol kom or wen enemies gada round mi?


Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey.


Raitious pipol and doz wey get respet go stay for di land wey bi awa own.


Una pipol go do di rite tin and dem go get di land forever. Na mi plant and make una, so dat evribody go know how I great rish.


Na dis kind tins pipol wey nor know God dey porshu and una Papa for heaven know sey una nid dem.


and as sin dey kontrol us thru deat, na so God grace dey rule thru raitiousness wey dey bring life wey nor dey end bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.


Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.


Una gate key go bi iron and bronze and God go guide una forever.


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


Dis na di promise wey Christ ensef promise us sey, di life wey e go give, nor go ever end.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ