All di pipol wey dey find Yu, make dem dey happy with joy, bikos of Yu! Pipol wey love to si sey Yu diliver dem, make dem always dey sey, “Make all di praiz bi God own!”
Di Oga yor God dey with yu and E dey always diliver yu. E dey happy well-well bikos of yu. En love nor go make yu fear again and E go dey sing sweet songs bikos of yu.’
Na so e bi for una naw, bikos una heart dey heavy, but I go si una again and for dat time, una go dey happy and nobody go fit take di happiness from una.