23 Make Yu raiz-up kom defend mi! My Oga God, make Yu take my matter like yor own.
Make Yu kom fight and protet my life just as Yu promise.
Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.
So, my God, make Yu wake-up! Wetin make Yu dey sleep? Make Yu get up! Make Yu nor rijet us forever.
Why Yu dey look di oda side? Wetin make Yu do like sey Yu nor know sey wi dey sofa and wiked pipol dey opress us?
I nor do anytin bad, yet dem dey wait to attack mi. Make Yu raiz-up kon si wetin dey happen, den help mi!
My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies! Abeg, raiz-up make Yu kom fight for mi!
Pipol for di world gada round Yu, so make Yu rule dem from yor throne.
Make Yu stop di bad tins wey wiked pipol dey do kon defend doz wey dey good, bikos my God wey dey good, know wetin dey pipol mind and heart.
My God, make Yu raiz-up kon fight for mi. Make Yu remember as dis fools dey curse Yu evriday.
to Efraim, Benjamin and Manasseh pipol. Make Yu show yor mighty pawa, den kom save us!
Den e go koll mi kon sey, ‘Yu bi my Papa, my God and di Rock wey dey save mi.’
Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.
Yu don si di bad-bad tins wey dem do mi. So my God, make Yu judge my kase, so dat pipol go know sey I dey rite.
Tomas ansa am, “O! My Oga God and my God.”