2 Make Yu wear yor war klot, ready for war, den kom save mi.
E go kover yu with en feada and na der yu go dey save. Na en promise wey nor dey fail, dey guide and protet us.
Awa Oga sabi fight war, na God bi en name.
Dem kom from far-far kountry; from evriwhere for di world. Yes! God dey vex kom skata di whole kountry.
God dey go fight war like strong soja; E dey ready to fight. E go shaut. Yes! E go shaut for war kon distroy and win en enemies.