19 Make Yu nor let my enemies happy sey dem win mi. Make Yu nor let pipol wey hate mi, even doh I nor do anytin, happy bikos I dey sofa.
Wetin make yu nor dey rizin well again? Wetin make yor eyes dey weak,
Dem gada round mi kon dey lie and fight mi without any rizin.
Pipol wey get pawa dey trobol mi wen I nor do dem anytin, but na only yor word dey make my heart shake.
Make Yu nor let my enemies dey make mout sey, “Wi don win am!” Den dem go dey happy sey I don fall.
Na only Yu I trust, so make Yu nor let pipol disgrace mi or allow my enemies happy wen I fall.
But wen I fall, dem go dey happy kon gada demsef togeda dey dance. Dem gada togeda to kause wahala for mi and dem nor gri stop or taya.
I dey pray, “Make Yu nor let my enemies happy, bikos I fall for groun.”
Na die I dey so o-o, bikos na so-so pain I dey face.
I get many wiked enemies and dem hate mi without any rizin.
Dem dey pay mi bad for good kon dey oppoz mi for di good tins wey I do.
Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!
My God Yu know all di sins wey I kommit for sekret; bikos my sins nor fit hide from Yu.
Pesin wey dey hide di trut dey kause trobol, but pesin wey dey tok am for publik, dey work for peace.
Dem go use dia eyes take make sign kon use dia legs and fingers take deceive pipol.
Pipol wey I nor do bad to, set trap for mi like sey I bi bird.
All dis tins happen, so dat wetin God law tok, go bi true sey, ‘Dem nor get rizin to take hate mi.’