Den, dem take Jesus komot from Kaiafas place go di Roman Govnor palis. (By dis time, morning don rish). Dem nor gri enter inside di govnor house, make dem nor for dirty as dia tradishon tok, so dat dem go fit chop di Passova food.
So wen wi dey celebrate Passova, make wi nor do am with di old yist wey bi wikedness and bad belle, but make wi do am with di fresh bread wey nor get yist, wey bi trut and betta mind.