Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 35:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Wen dem dey sick, I dey sorry for dem. I dey ponish mysef as I dey fast for dem. If I dey lie, make God nor ansa my prayers!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 35:13
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Abi I nor follow pipol wey dey trobol kry kon sorry for pipol wey nor get at-all?


Doz wey dey sidan for di town gate dey tok about mi and pipol wey don drink, dey sing and laf mi with dia song.


Di pipol ask, “Wetin make us dey fast and honbol awasef if God nor go ansa us?” God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast, una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.


Na di kind fasting wey I choose bi dis? Na only di time wey una dey fast una dey-dey honbol? Na just to skrape di hair for una head rish groun, I wont? Abi, na to just wear sak kon sleep for ashes? Na dis one una dey koll fasting, di day wey God wont?


“Dis na di law wey una go obey forever. For di tent day for di sevent mont, Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem must fast and dem must nor do any work.


Dat day go dey very holy, dem go fast and dem nor go do any work at-all. Dem go keep dis law forever.


And if di pipol inside di house welkom una, make una peace stay with dem, but if dem nor welkom una, una peace go kom back to una.


But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’,


If anybody wey wont peace dey der, una peace go stay with am, but if e nor dey, una peace go kom back to una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ