Una go si dis tins kon happy; una go dey happy as una dey waka. Dem go bring all di nashons propaty kom give una. Dem go bring dia money from di oda side of di river kom.
Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.
So David and en six hundred men kon run komot Keilah; dem kon dey go from one place to anoda. Wen dem tell Saul sey David don run komot Keilah, e nor kon go der again.