E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.
David kon tink am sey, “One day Saul go kill mi. So, di best tin wey I go do naw, na to run go stay Filistia pipol land. Den Saul go stop to look for mi for evriwhere wey bi Israel own and I go free from en wahala.”