King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”
Evribody must chop am inside di house where dem for prepare am and make dem nor karry am from one house go anoda. Make una nor break any of di animals bone.
So, Saul kon tell en savant wey dey karry en swod sey, “Draw yor swod make yu stab mi, so dat Filistia sojas wey dem nor sekonsaiz, nor go kill mi.” But di savant nor gri stab am, bikos e dey fear. So Saul take di swod kon kill ensef.