20 God dey protet en pipol well-well and E nor go let any bad tin happen to dem,
E go save yu from trobol six times and wen e rish di sevent one, evil pipol nor go fit tosh yu.
I go praiz God with all di bones wey dey my body kon sey: “Na who I wont take kompare with my Oga God? Na who go fit save pipol wey nor strong from pipol wey strong? Na who go fit protet pipol wey nor get help and poor pipol from tif?”
But God go save doz wey dey fear am and na-im go protet dem wen dem dey for trobol.
God go help and save dem from wiked pipol. E go save dem with en pawa and dem go dey save inside am.
Dem go use dia hand karry una up, so dat una nor go even kick or fall on-top stone.
Wiked pipol words dey put dem for wahala, but raitious pipol go eskape from trobol.
All dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey, “Dem nor go break one singol bone for en body.”
Just as I save yor life today, make God save mi from evry trobol and wahala!”