15 Pipol wey dey do wetin dey rite, God eye nor dey komot from dia body and en ear dey open to hear wen dem kry for help.
My God, make Yu dey listin and ansa all di prayers wey dem go pray to Yu from dis place.
E dey protet good pipol; E dey let dem live like kings and pipol dey respet dem forever.
My Oga God, make Yu listin and hear mi as I dey kry for mesi!
But God dey guide doz wey dey fear am; doz wey bilive en love wey nor dey fail.
God dey hear en pipol wen dem koll am for help. E dey save dem from all dia wahala.
I pray to God as I dey sofa and E ansa mi; E save mi from evritin wey dey worry mi.
So, make yu turn from bad tins kon do good and yu go stay for di land forever.
But dis na wetin una go do: ‘Make una always dey tell each oda di trut. Make una judge well, di kind judgement wey dey bring peace.
“Di fasting wey Judah pipol dey do for di fourt, fift, sevent and tent mont, go kon bi festival for joy and for betta tins. Una must love trut and peace.”
God dey si di pipol wey dey do good and en ear dey open to hear dia prayers. But E dey against pipol wey dey do bad.