Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 34:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 E get anybody wey won live betta life? Anybody like to get long life?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 34:12
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Make una listin to mi, una wey bi Jakob shidren; make una listin to Israel wey bi una papa.


But if yu nor get, make yu kwayet listin to mi and I go tish yu wisdom.”


My God! Make Yu remember sey my life bi like breeze and my happiness don end.


Wen e sey make Yu save en life, Yu do evritin wey e ask for and en family go rule forever.


Many pipol dey sey, “Who go fit show us wetin dey good?” So my God, make Yu smile for us.


I go bless dem with long life and give dem my salvashon.”


So, my pikin, make yu hear wetin I dey tok kon listin to my words.


So naw, my pikin, make yu listin and hear wetin I dey tok.


If yu won get wisdom, yu go first fear God. If yu know di One wey dey holy, den yu don get undastandin.


So, since yu don hear evritin, dis na my last advise: “Make yu fear God and obey all en kommands, bikos na wetin man suppose do, bi dat.”


I really tink well-well about wetin wine go fit do for mi. I bilive sey na wisdom I dey use and I nor go bihave like fool, so dat I go know wetin dey good for pipol to do for dis world, as dem dey live dia life wey go soon end.


So, make pipol chop, drink and enjoy wetin dem work for, bikos all dis tins na God gift.


Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”


Una go make sure sey una respet Oga God and obey all en statutes and kommandments wey I dey give una – una, una shidren and grand-shidren – go obey am with all una life so dat una go get long life.


As for mi, God forbid sey I nor go dey pray for una again, bikos dat na sin. I go tell una di tin wey dey good and wey dey make belle sweet God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ