Di men work with all dia mind and di four Levi men wey dey supavise dem na: Jahat and Obadaya from Merari; Zekaraya and Meshullam from Kohat family. (All Levi pipol wey dey der, sabi sing well-well.)
Make una sing new song to God! Make evribody for di world sing praiz God. Una wey dey drive on-top di sea and evry oda tins wey E kreate for inside, make una sing praiz am. All di far land and doz wey dey der, make una praiz am.
Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.
Dem kon dey sing new song for di throne, di for creatures and di eldas front. Nobody fit learn di song, escept di 144,000 pipol wey God save from dis eart.
Dem kon dey sing new song sey: “Yu holy rish to take di book kon open di keys, bikos dem kill yu and na yor blood save all God pipol from evry tribe, language, group and kountry.