22 My God, make yor love wey nor dey fail, protet us, bikos na Yu bi di hope wey wi get.
Make Yu remember di promise wey Yu make give mi, bikos na-im bi my only hope.
Naw, make yor love wey nor dey fail, konfort mi, just as Yu promise mi wey bi yor savant.
But I trust yor love wey nor dey fail. I go happy, bikos Yu don save mi.
Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.
So my God, make Yu sorry for us, bikos na Yu wi put awa hope on. Make Yu dey protet us evriday kon save us from trobol.
Den Jesus tosh dia eyes kon sey, “Make e happen to una as una faith strong rish.”