Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 33:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Na-im make dia heart, so E undastand evritin wey dem dey do or tink.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 33:15
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Na di same hand wey Yu take make mi, Yu won take skata mi?


God know pipol wey dey lie; E dey si all di sins wey dem dey kommit.


E go know, bikos E know wetin dey evribody mind.


Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi, bikos na God kreate two of dem.


If yu fit sey e nor koncern yu, God know and dey judge evritin wey yu dey do. E dey look yu and E know yu well-well. E go reward yu akordin to wetin yu do.


Na yor own face dey shine for di wota wey yu dey look and na yor ownsef yu dey si for yor heart.


But I still learn dis one too: God kreate evribody make dem dey good, but dem don dey do wiked tins as dem like.”


But Oga God, na Yu bi awa papa. Wi bi klay and na Yu mold us. Na Yu kreate us,


Bikos I dey si evritin wey dem dey do; dia wikedness nor hide from mi and e nor get where dem hide dia sin put wey I nor go si am.


Yu dey make betta plan kon do mighty tins. Yu know evritin wey pipol dey do and Yu dey reward dem akordin to wetin dem do.


Dem nor know sey, I remember all di bad-bad tins wey dem do. Dia sin plenty well-well and I dey si all di wiked tins wey dem dey do.


Na thru one man E make all di tribes wey dey di world and E tok di time and place where dem go find God rish,


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ