13 God dey look from heaven. E dey from der look all di pipol wey E kreate.
God look di eart kon si sey e dey bad well-well, bikos all di pipol dey live wiked life.
E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”
God know pipol wey dey lie; E dey si all di sins wey dem dey kommit.
bikos E dey si di end for di eart and E dey si evritin wey dey under di sky.
Make una tell dem sey God dey look down from en temple for heaven. E dey look di eart from heaven
But God dey for en holy temple; E dey rule from heaven. E dey look as evribody dey live dia life for dis eart.
God dey look evribody from heaven; E dey look to si if anybody really get sense and dey find am.
God dey from heaven look evribody; E dey look to si if anybody really get sense and weda anybody really dey find am.
Na en great pawa E take dey rule forever. E dey si evritin wey di nashons dey do; so make wiked pipol nor dey karry body.
God dey wosh evriwhere, E dey wosh both good and wiked pipol.
until God go look from heaven kon si wetin don happen.
Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.