Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 33:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Si as blessing full di nashon wey God bi dia God, bikos God don take dem as en own.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 33:12
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Awa town na big one wey get peace and pipol dey respet us for Israel. Why yu won distroy am? Yu won skata wetin bi God own?”


True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.


Yes! Di pipol wey dis kind tin dey happen to, go happy! True-true, doz wey God bi dia God, go happy well-well.


So God, make Yu save yor pipol! Make Yu bless Israel pipol wey bi yor special propaty. Make Yu guide dem like shepad kon karry dem for yor hand forever.


But blessing go follow di pesin wey Yu choose to stay yor palis. Make di good tins wey dey yor house, yor holy place, beleful us.


kon sey, “My Oga God, if I really dey good for yor eye, make Yu go with us, bikos wi bi sturbon pipol; make Yu forgive us awa evil and sin kon take us as yor pipol.”


So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.


Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. En name na God wey dey mighty.”


Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.


Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy.


Na God get di pipol for Israel; na Jakob bi en special propaty.


Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”


E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ