Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 33:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 But God plan go stand forever; wetin E plan, nor go shange at-all.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 33:11
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem nor tell yu sey na mi plan all dis tins before dem happen? I don do as I plan dem. Na mi give yu pawa to turn towns wey dem guide well-well, to where dem dey trowey dirty put.


E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.


Wi dey si di great work wey Yu do! Di tins wey Yu dey tink, deep well-well.


Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.


Bikos I know sey anytin wey God do, na final and e go dey forever; dem nor go fit add anytin join am or remove anytin from inside. God make evritin like dis, so dat pipol go fear am.


God wey dey lead heaven sojas swear sey, “Make una know sey na as I plan am, na so e go bi and as I tok am, na so e go happen too.


True-true, God wey dey lead heaven sojas get plan and who go fit stop wetin E won do? En hand dey ready to ponish anybody. So who go fit stop am?


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


Bikos I know wetin I plan for una; my plan na to make una prosper, nor bi to give una wahala and na to give una di kind future wey una dey hope to get.


So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?


Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.


But dem nor know wetin God dey tink; dem nor undastand en plans. Dis pipol nor know sey God dey gada dem, so dat dem go beat and mash dem pass like korn wey dem mash for groun.


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ