1 Una wey dey fear God, make una sing with joy; bikos e dey good make pipol wey get pure heart, praiz am.
Na songs for joy and viktory dem dey sing for di kamp of pipol wey dey fear and obey God, bikos God don do wonderful tins with en strong rite hand!
make una praiz am, bikos E dey good! Make una sing praiz en name, bikos dat na wetin una suppose do!
Make wi praiz God! Si as e dey good to sing praiz God! Yes, na to praiz God bi di rite tin to do!
So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!
So make evribody wey dey fear God, happy kon praiz en holy name!
God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.
Just as God word sey, “Nobody dey raitious.
Bikos Adam nor obey God, many pipol bigin sin. But since Jesus obey God, many pipol go obey God too.
Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!