24 So evribody wey put dia trust for God hand, make una nor fear, instead make una get strong mind!
Di king stand near di pila kon make new kovenant with God sey dem go follow en kommand, laws and rules wey dem rite for di book with all dia heart.
Den di king tell Haman, “Make yu go kwik-kwik! Kollect di garment and horse, den do all dis tins wey yu tok for Mordekai, di Jew wey dey di palis gate.”
Wen I pray, na wons Yu dey ansa mi! Yu enkourage mi kon give mi strent.
But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope, dey inside di Oga God and na joy dey follow dem.
So, make yu dey patient, as yu dey wait for God and get strong mind. Yes! Make yu dey patient, as yu dey wait for am.
Na God dey give en pipol strent and na en dey bless dem with peace.
So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.
Wi still dey pray sey una go dey strong with God pawa wey get glory. Una go show sey una dey patient and get strong mind for God work with happiness.
True am, una bilive God wey raiz am from deat kon gi-am glory. So, una faith and hope dey for God hand.