Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 31:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Si as yor favor great rish; di one wey Yu keep for doz wey dey fear Yu. Yu dey pour dem on pipol wey kom make Yu protet dem and Yu dey bless dem for evribody front.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 31:19
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”


Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.


E dey give mi food to chop for my enemies present. E pour oil for my head and my cup kon full dey trowey.


But God don kommand sey una go get pawa well-well. So, my God wey help us wen wi nor even know, make Yu show yor pawa


True-true, God dey good to Israel pipol and to doz wey dia heart dey pure.


My God! Na Yu make us dey save and dey prosper and even evritin wey wi get, na Yu give us.


Dem go dey happy, dey sing and shaut with joy till dem rish Jerusalem. Dem go dey happy forever and dem go dey free from sorrow and pain.


Nobody don si or hear about any oda god wey bi like Yu or di one wey fit do di kind tins wey Yu dey do for doz wey put dia hope on Yu.


Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’


But di pesin wey dey do good tins, dey kom out for lite, so dat pipol go si di tins wey e dey do, bikos na as God wont naim e dey do.”


Evribody wey dey for der kon kwayet dey hear wetin Banabas and Paul dey tok and dem tell dem about di mirakles and wonders wey God use dem do among Gentile pipol.


Naw, una don si how God dey good and harsh. Even doh E dey vex for doz wey fall, E still dey kind to una. And E go always dey kind to una, as long as una dey do wetin E wont. If not, E go rijet una too.


But God word sey, “No eye don ever si; no ear don hear, even pesin mind nor fit tink about di tins wey God don prepare for pipol wey love am.”


Naw, di Pesin wey prepare us for dis tins, na God wey give us di Spirit, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E get for us.


True-true, una sofa like oda prisonas and una dey happy wen dem seize all una propaty, bikos una know sey una get betta tin wey go last forever.


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ