Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 31:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 But my Oga God, I trust Yu, bikos na Yu bi my God!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 31:14
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Josef brodas si am dey kom from far and before e rish where dem dey, dem kon plan to kill-am.


So I tell Oga sey, “Na Yu bi my God!” So my Oga God, make Yu listin wen I dey kry for help!


Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am.


Wetin make my soul dey weak? Wetin make my heart nor happy at-all? But I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and God!


Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.


So, my God, make Yu nor leave mi, but make Yu hurry kom save mi.


Den I go praiz Yu with harp, bikos Yu dey faithful to yor promise. My God, I go use jita take sing praiz Yu wey bi di Holy One for Israel.


I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”


E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”


Jesus kon go pray for di sekond time, “My Papa, if yu nor won take dis deat komot unless I die, den make wetin yu wont happen.”


Wen three oklok won rish, Jesus Christ kon shaut, “Eli, Eli, lema Sabaktani?” wey mean, “My God, My God, wetin make yu abandon mi?”


Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ