11 All my enemies dey laf mi and my neighbours hate mi; even my friends dey fear to waka near mi and wen dem si mi dey kom, dem go rush pass anoda road.
God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”
Bikos boy pikin go rijet en papa and na so too girl pikin go rijet en mama. Wife go sey e nor know en husband mama and una enemy, go bi una family memba!