10 I dey die bikos pain and sadnes don make my years short. Sin don finish my strent and na die I dey die so.
Instead make I chop, I dey kry and my pain dey pour kom out like wota.
How long I go dey struggol with pain inside my soul and get sorrow for my heart? Na how long my enemies go always dey opress mi?
So my God, make Yu hear my prayer. Make Yu show mi mesi!
and bikos Yu dey vex, my body nor dey strong again, bikos of my sin.
Wen Yu ponish us for awa sins, Yu dey remove awa pawa like rat wey dey chop pesin food. But each of us, na just breeze wey dey blow pass.
All of una wey dey do bad tins, make una leave mi alone, bikos God don hear my kry.
Naw, for my old age, make Yu nor rijet mi. Make Yu nor leave mi wen I nor dey strong again.
So E kon make dem die with disgrace and dia years kon end with shame.
Na since wen I dey small Yu allow pipol dey opress mi and I don nearly die. Yu don ponish mi well-well and naw, na pains full my life.
e dey pain mi for mind and sorrow full my heart,