Awa Oga God, Yu nor go judge dem? Wi nor get pawa rish dis plenty sojas wey dey kom attack us so o-o. Wi nor know wetin wi go do, so wi kom meet Yu make Yu help us.”
‘If wahala kom meet us like sojas attack us, judgement, sickness or sey food nor dey, wi go kry kon meet Yu with awa pain, so dat Yu go hear and diliver us.’
“Naw, make una go house go celebrate. Share food and wine with pipol wey nor get. Today na holy day for awa Oga God, so make una nor kry, bikos na God happiness dey make una strong.”
bikos na doz days Jew pipol take win dia enemies. Na den dia problem and wahala turn to smile and happiness.” Doz days go bi wen Jew pipol free diasef from dia enemies, so dem go share gifts among demsef and dash poor pipol gifts too.
God wey get pawa go distroy and swallow deat forever! Doz wey dey kry, God go klean dia eyes and E go remove di disgrace wey en pipol don sofa for dis world. God, wey dey lead heaven sojas, don tok.
Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.
E sey, instead of sadnes, E go give joy and happiness to doz wey dey mourn for Zion. Instead of sorrow, E go put praiz song for dia mout. Dem go bi like tree wey God plant by ensef. All of dem go do wetin dey rite and dem go praiz God for wetin E don do.