1 Make all di angels for heaven honor God; make una honor am, bikos of en glory and strent.
God dey pawaful as E dey kom from en temple. Israel God dey give pawa and strent to en pipol. So make all praiz bi en own!
Even angels dey honor am wen dem gada togeda and E great pass evribody wey dey round en throne.
But dem go distroy any nashon wey nor gri serve una.