Oga God Almighty wey bi Israel pipol God! I dey pray dis prayer with all my heart, bikos Yu don show mi yor savant, all dis tins kon promise mi sey, ‘Yu go make my shidren-shidren king forever.’
If yu obey and follow my laws and yu win my heart as yu dey obey my kommand, just as David my savant do, I go always dey with yu. I go make yu king for Israel and I go make sure sey yor shidren-shidren go rule afta yu, just as I do for David.
Una make somewhere inside di town where una go dey store wota wey dey flow kom from di old pool. But una nor trust God wey make am. Una nor gri depend on God wey make all dis tins.
Make una look di sky! Who make di stars wey una dey si? Na-im dey lead dem like sojas. E know how dem plenty rish and E dey koll all of dem by dia name! En pawa big well-well and no one among di stars dey miss.
Na mi bi di Pesin wey kreate di eart and na mi kreate di pipol wey dey stay inside. Na my pawa I take stresh di heavens out kon kontrol di sun, moon and di stars.
God wey kreate di heavens and di eart sey, na-im still bi God! Na mi kreate di eart well and I nor kreate am to dey empty, but na for pipol to stay. E sey, “Na mi bi God and e nor get anoda one.
I go send viktory kom from di sky like rain, so make di eart open and receive am; so dat salvashon and korrect judgement, go grow. Mi, wey bi God, go make dis tins happen.”
Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.
Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’
From di time wen God kreate di world, E don show us di tins wey ordinary eye nor dey fit si; E show us en pawa and life thru di tins wey E kreate. So wiked pipol nor get eskuse at-all.