Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 25:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Na God I always dey look up to, bikos na-im save mi from di trap wey my enemies set.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 25:15
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My king, Israel pipol dey wait make yu tell dem who go bi king afta yu.


Awa Oga God, Yu nor go judge dem? Wi nor get pawa rish dis plenty sojas wey dey kom attack us so o-o. Wi nor know wetin wi go do, so wi kom meet Yu make Yu help us.”


Just as savants dey depend on dia masta and as savant girls dey depend on dia madam, na so wi too dey depend on di Oga awa God, until E go favor us.


But my Oga God wey get pawa, I dey look up to Yu. Na Yu bi my guide; so make Yu nor let dem kill mi.


Drag mi komot from di trap wey my enemies set for mi, bikos na only Yu fit protet mi.


Wiked men dey stay among my pipol, dem dey wait like pipol wey dey spread net to katch bird or set trap to katch pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ