Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 25:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 God na friend to doz wey dey fear am and E dey tish dem en kovenant.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 25:14
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Una must sekonsaiz evry pikin and dis go bi sign to show sey my kovenant with yu, go bi forever.


bikos God hate pipol wey dey do evil, but E dey draw raitious pipol near body.


God tell mi, “Make yu go tell di king and en mama sey, make dem komot for di throne, bikos dia fine crown don fall komot for dia head.


Naim bi di Spirit wey dey tok trut, wey pipol for dis world nor go fit receive, bikos dem nor fit si am or know am, but una know am, bikos e dey stay inside una.


I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.


I don make di pipol wey yu give mi for dis world know yor name. Na yor own dem bi before yu give dem to mi and dem don obey yor word.


Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.


So, na only who get God Spirit fit undastand spiritual blessings. Pesin wey nor get God Spirit, nor go fit undastand wetin di Spirit dey tok.


Una eye don open to undastand di grace wey God koll una kom enter and una don si how di blessing wey E promise en pipol, plenty rish.


E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.


E give una en kovenant. E kommand sey make una dey obey di ten kommandment wey dem rite for two stone.


bikos una don die and una life dey save with Christ for inside God.


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go gi-am some manna wey dem hide for heaven. I go gi-am white stone and for dat stone, dem go rite new name put and nobody go fit undastand am, escept di pesin wey I give di stone.’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ