23 Evribody wey dey fear God, kom make wi praiz am! All Jakob shidren-shidren, make una kom make wi honor am!
Make I share for di joy wey Yu dey give to di pipol wey Yu choose. Make I happy, bikos yor pipol dey happy; make I praiz Yu with doz wey bi yor own.
But I go always dey tank God kon praiz am for evribody front,
Make wi Praiz God! I go tank God with all my heart for di pipol front wey dey obey and gada woship am.
All of una wey dey obey God, make una trust am, bikos na-im dey help and guide una.
E go bless di pipol wey dey obey am; both small and big.
Pipol wey dey fear am, E dey give dem wetin dem wont; E dey hear wen dem dey kry for help kon save dem.
Awa shidren sef go serve Yu. Awa shidren-shidren go hear about di wonders wey God don do.
Naw, I dey save and I don join di pipol wey dey woship Yu, so I go praiz my God.
So, make di whole world fear God and make evribody kom bless en name.
Den I go tank Yu for where yor pipol gada put. I go praiz Yu for all yor pipol front.
But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”
My Oga and God, I go praiz Yu with all my heart, I go give glory to yor name forever,
Pipol from strong kountry go praiz Yu and wiked pipol from oda towns, go fear Yu well-well,
E dey show en mesi to evribody wey dey fear am for evry generashon.
So di shepads go back, dey praiz God, bikos of all di tins wey dem hear and si. Evritin just bi as di angel tell dem sey e go bi.
But anytin wey una dey do, weda una dey chop or drink, make una do am to honor God.
Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”