22 I go tok about yor name for where my kountry pipol dey. I go praiz Yu for where yor pipol gada put.
I go praiz Yu for where yor pipol gada. Doz wey dey woship Yu, na for dia present I go for do wetin I vow.
I go tank Yu wey bi my God for where evribody dey. I go sing yor praiz among all di nashons.
“Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’
Den Jesus Christ tell dem, “Make una nor fear, but tell my brodas make dem go Galilee and dem go si mi for der.”
Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”
God know doz wey E don choose, so E don make dem bi like en Pikin, so dat en pikin go bi di first-born.