6 Yor blessing bi like klot for en body and Yu gi-am joy for yor present.
“Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing.
I dey follow yu go anywhere wey yu dey go and I dey make yu win all yor enemies as yu dey fight. I go make evribody know yu for evriwhere, just as dem know all di big leaders for di world.
And naw, Yu don choose to bless my family so dat wi go dey with Yu forever, bikos if Yu my God bless pesin, di blessing go dey forever.”
Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.
For der, I go-go God altar; di God wey dey give mi joy kon praiz am with my harp!
Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins. So Oga wey bi yor God don anoint yu as E pour en oil for yor head kon make yu high pass any oda pesin.
“True-true, yu don show mi di way wey dey give life and yu go make mi happy well-well wen I dey for where yu dey.” ’
So God don raiz en savant and E don send am give una, make e for bless and help una turn from sin kom meet am.”
so thru Christ, Abraham blessings go kom meet Gentile pipol and wi go receive di Spirit wey God promise us, thru faith.
So pipol wey bilive, God go bless dem togeda with Abraham, bikos dem bilive.
I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.