11 Aldo dem plan against Yu, dia wiked plan nor go work.
Wiked pipol dey porshu and ponish poor pipol. So make di evil trap wey dem set for oda pipol, katch dem.
Make all en shidren die, so dat pipol nor go remember en family name again.
Wetin make pipol wey dey dis world dey vex? Wetin make dem dey make plans wey go fail?
I don hear evritin wey dem dey tok and e dey make mi fear. My enemies gada dey plan how dem go take kill mi.
Dem nor dey tok about peace. Dem dey plan against innocent pipol wey dey mind dia business.
Dem dey sey, “Make una kom make wi kill evribody for Israel finish and nobody go remember dem again.”
So God tell mi, “Dis men dey plan evil and na wiked advise dem dey give Jerusalem pipol.
Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.
E kon sey, “Make una go look for di pikin well-well. Wen una don si am, make una kom tell mi, so dat mi too, go-go woship am.”
So dem kon dey try to arrest Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol bilive sey na profet e bi.”