10 Dem betta pass silva and even gold wey fine well-well. Dem sweet pass honey; even di honey wey dey fall from bee house.
I dey always do wetin E tok; dey follow en words; nor bi my own.
Yor word sweet well-well for my mout; dem even sweet pass honey.
True-true, I love yor kommand pass gold and I even love am pass di gold wey fine pass.
Yor kommand dey good to mi pass plenty silva and gold.
Just as meat dey satisfy pesin na so too Yu satisfy my soul. So my mout go always dey praiz Yu
E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.
My pikin, make yu chop honey bikos e good. Just as honey sweet for yor mout,
Anytin wey una get from mi, betta pass di gold wey fine pass and silva wey pure well-well.
So, I take di book from di angel hand kon chop am. True-true wen I dey chop am, e sweet like honey for my mout, but wen I swallow am, e kon bitter for my belle.