26 To pipol wey get pure heart, Yu dey show dem as Yu pure rish, but to wiked pipol, Yu nor dey sorry for dem at-all.
God nor get wetin E won do with proud pipol, but E dey favor pipol wey dey honbol.
Israel pipol suppose tok like dis? God Spirit go get patient with dis kind karata? But if una go gri do wetin dey korrect, my word go konfort una.
Anybody wey dey do bad tin, weda e bi Jew or Gentile, must sofa and receive ponishment.
Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.
“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!