King Josaya remove all di juju from Israel pipol aria kon advise dem sey make dem serve God. For di time wen Josaya dey rule, di pipol nor sin against di Oga wey bi dia grand-grand papa God.
Di king kon dey happy, so e orda make dem bring Daniel kom out from di pit. Dem bring Daniel out from di pit and e nor get sore for body or any mark, bikos e bilive di God wey e dey serve.
Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.
“I dey regret sey I make Saul king, bikos e don turn from mi and e nor do wetin I sey make e do.” Samuel kon vex well-well and e pray to God till day break.