Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 17:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 My Oga God, make Yu raiz-up! Make Yu stand against dem kon nak dem fall! Make Yu use yor swod take save mi from wiked pipol!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 17:13
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So my God, make Yu raiz-up kon ponish wiked pipol! Make Yu nor leave doz wey nor get who go help dem!


E don rish time wey God go take akshon, bikos dis wiked pipol dey break en laws.


Make Yu save mi from di swod kon guide my life from doz dogs.


My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!


So, my God, make Yu wake-up! Wetin make Yu dey sleep? Make Yu get up! Make Yu nor rijet us forever.


So my God, make Yu kom help us! Save us bikos of yor love wey nor dey fail.


My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies! Abeg, raiz-up make Yu kom fight for mi!


Naw, who go protet mi from wiked pipol? Who go help mi fight doz wey dey do evil?


But God sey, “Axe go fit sey e big pass di man wey dey use am? Abi cutlass dey important pass pesin wey dey use am kut sometin? Nor bi gun dey karry pesin wey hold am, but na di pesin dey karry am.”


God sey, “I dey use Assyria pipol as weapon to take ponish pipol wey I dey vex for.


Dem kom from far-far kountry; from evriwhere for di world. Yes! God dey vex kom skata di whole kountry.


So, yu neva hear sey na so I plan all dis tins since? And naw, I don do am; bikos na mi give yu pawa to take skata all di towns wey dem protet.


Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.


My Oga God, di Pesin wey dey holy, Yu wey dey since and go always dey. Oga God wey bi awa Rock, Yu nor dey plan to kill us finish, Yu only send Babilon pipol to kom korrect and ponish us bikos of awa sin.


and dem dey do wetin yu don already plan sey go happen.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ