11 kings for di eart and all di pipol; doz wey dey rule and judge di eart;
Just as di nashons go fear wen dem si God, na so too kings go fall wen dem si en glory,
Oga God, all di nashons wey Yu make, go kom bow down for Yu and dem go praiz yor holy name,
Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
Nashons go kom enter una lite and kings go enter una brite lite.
Na di town lite go show pipol road and di kings wey dey for di world go bring evritin wey dem get kom inside.