Si as e dey good to si messenja wey dey kom give una peace and good news from di mountins! E dey announce sey una don win kon tell Zion pipol sey, “Una God na king!”
Zion pipol, make una happy, bikos of wetin Oga God do for una. Bikos E don give una rain. E send both di early and late rain kom meet una, just as E dey do before.