7 Evribody go tok di story about di wonderful tins wey Yu don do; dem go sing with joy about yor raitiousness.
Make Yu pour yor love wey nor dey fail on pipol wey love Yu; make Yu judge well for pipol wey get klean heart.
My God wey dey save pesin, make Yu forgive mi, bikos I don kill pesin; den I go sing about yor forgivenes with joy.
My God, yor good judgement dey rish di heavens and Yu don do many wonderful tins, so na who bi like Yu?
Dem dey happy evriday bikos of di wonderful tins wey Yu dey do and yor raitiousness dey save dem.
I go tok about God love wey nor dey fail. I dey praiz am for wetin E don do for us. E don bless Israel pipol well-well, bikos of en mesi and love wey nor dey fade.
Wen e bikom king, Judah pipol go dey save and Israel pipol go stay for peace. Dem go koll am, ‘Na God bi awa raitiousness.’ ”