Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 145:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 God dey klose to all di pipol wey dey koll am for help; Yes! E dey klose to evribody wey dey koll am with klean mind.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 145:18
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But my Oga God, Yu dey near and all yor kommand na true


Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish.


My Oga God, make Yu hear my kry for help, den judge my kase. Listin to my prayer, bikos na trut I dey tok.


Pipol wey nor get hope, God dey-dey near dem; E dey save doz wey dia spirit dey die.


Na God bi di strong place wey wi dey hide put and na-im dey help us wen wi dey trobol.


Bikos God dey stay di town, e nor go skata. Na from wen day just break, God dey protet am.


God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


Wen una pray, I go ansa una. Wen una koll mi, I go hear una. If una stop to opress pipol and tok wiked words kon stop wiked tins;


Yes! Wen I koll Yu, Yu kom tell mi sey, ‘Nor fear.’


Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.


“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.


Jesus ansa am, “Anybody wey love mi, go do wetin I tok and my Papa go love am, den wi go kon meet and stay with am.


God na Spirit and di pipol wey won serve am, must serve am for di true way wey God Spirit go show dem.”


In-short, e nor get any oda kountry wey dia gods dey klose to dem like di Oga awa God wey dey ansa wen ever wi koll am.


Draw near God and E go draw near yu. Una wey bi sina, make una wosh una hand and una wey get doubol mind, make una heart dey klean.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ