Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 145:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 bikos yor kingdom go dey forever and ever. Yu dey rule from one generashon go rish anoda.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 145:13
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na God bi king forever and ever! Di pipol wey nor dey fear God, go vanish komot from dis world.


So God go rule forever. Jerusalem pipol, E go bi una God from one generashon go rish anoda. So, make wi praiz awa God!


En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.


So Yu my Oga God, go rule forever and ever! Yor throne go dey from one generashon go rish anoda one.


For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.


As e still dey tok, one vois kom from heaven kon sey: “King Nebukadnezzar, make yu hear wetin I dey tok, God don komot yor kingdom from yor hand!


E dey perform mirakle and wonders for heaven and for dis eart, E dey diliver and save pipol well-well. E don save Daniel from lions mout.”


Dem gi-am authority, honor and pawa to rule. Evribody, nashon and pipol from difren tribe, go serve am. En pawa go last forever and nobody go fit distroy en kingdom.


Di pawa and great tins wey di world get, God kom gi-am to pipol wey dey serve am. Dia royal pawa nor go ever end and rulers go serve and respet dem.’


Make all di honor and glory bi God own forever and ever! Na-im bi di King wey nor dey die, di One wey nobody dey si and na only en bi God. Amen!


Di door to enter awa Oga God and Savior Jesus Christ kingdom, wey nor go ever end, go open wide for una.


Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ