6 Make Yu shine yor lite kon skata yor enemies! Make Yu shot yor arrow kon konfuse dem!
Den as God kommand and as E just breath, di sea bottom open and di eart foundashon kon dey show.
Dem go turn and run from Yu, bikos of yor arrow wey Yu shot.
Yor arrows sharp, e dey shuk yor enemies for dia heart and nashons dey fall for yor leg.
Na dia own bad word go kill dem. And anybody wey si dem, go shake en head kon sorry for dem.
I go inkrease dia wahala, I go use all my arrow for dia body.
I go make my arrow full with blood and my swod go distroy pipol flesh, doz pipol wey I katch and kill and even di enemies oga blood!’ ”