Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 144:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Yes! Di pipol wey dis kind tin dey happen to, go happy! True-true, doz wey God bi dia God, go happy well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 144:15
7 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen King Hezekaya with en ofisas si wetin dem gada, dem praiz God kon bless di pipol.


But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope, dey inside di Oga God and na joy dey follow dem.


Si as blessing full di nashon wey God bi dia God, bikos God don take dem as en own.


But blessing go follow di pesin wey Yu choose to stay yor palis. Make di good tins wey dey yor house, yor holy place, beleful us.


Pipol wey dey woship Yu, dey always dey happy; dem go waka for di lite wey dey yor present, bikos Yu don favor dem.


I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.


Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ