Jabez kon pray, “Israel God, make Yu bless mi and let my land big well-well. Make yor hand dey with mi kon save mi from trobol, so dat sofa nor go kill mi!” So God kon ansa en prayer.
E rish one place where sheep dey for di road side and rock wey whole dey inside, dey der too. Den e go inside di rock go rest. Naw, David and en men sidan for di rock back (Dem hide for der).
David men kon tell am, “Today na di day wey God tell yu about sey, ‘I go put yor enemy for yor hand and yu fit do am anytin wey yu like.’ ” So David kon stand up small-small go kut di korna for Saul klot.