Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 139:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 So my God, si as I hate pipol wey hate and dey oppoz Yu!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 139:21
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.


I dey kry like river wey dey flow, bikos pipol nor gri obey yor kommands.


Wen I si lie-lie pipol, e dey make mi sick, bikos dem nor kare about yor kommandment.


Doz wey hate pipol wey dey sin and honor doz wey dey fear and follow God! Pipol wey dey do wetin dem promise even wen e dey pain dem.


I hate to dey where bad pipol dey and I nor go ever follow wiked pipol waka.


I hate pipol wey dey serve juju, but I trust Yu wey bi my Oga God.


But as una nor gri listin, I dey kry for sekret, bikos of una pride; I go kry well-well till I nor fit kry again, bikos dem don karry God pipol go as slave.”


So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.


Wen Jesus near Jerusalem, e look di town kon dey kry,


I know yor work. I don si evritin wey yu do and even as yu dey wait with patient. I know sey yu nor like wiked pipol. Yu don test pipol wey sey dem bi apostles, but dem nor bi, bikos yu si sey, dem dey lie.


But all dis tins dey happen make e for betta for yu, bikos yu hate di tins wey Nikolaitan pipol dey do and I hate doz tins too.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ