20 Dem nor gri do wetin Yu kommand; dem like to dey do wiked tins and awa enemies dey like to lie well-well.
My God, si as di enemies dey curse Yu. Pipol wey nor get sense nor dey respet yor name.
Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos I go ponish anybody wey do like dat.
“ ‘Who yu tink sey yu dey curse and laf since? Yu nor dey respet mi wey bi Israel God wey dey holy.
e dey kom judge evribody, so dat pipol go know di bad tins wey dem dey do and di wiked words wey sinnas don tok against God.”
So di beast open en mout dey curse God, en name, where E dey stay and doz wey dey heaven.